14 Job, make yu wait small kon listin; konsida all di wonderful tins wey God don do,
Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do. So, yusef must praiz am.
God wey dey send rain kom wota di eart, fit still send am kom ponish or favor us.
den yu go know how God take dey give kommand and how E take make di lite flash for di kloud.
Yu know how di kloud take hang for sky? Dat na one tin wey God do wey dey sopraiz evribody.
Wen God tok, e dey bi like tonda and wonderful tins dey happen; tins wey wi nor fit undastand.
Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.
Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.
God sey, “Make una stand for where una dey, den una go know sey na mi bi God! Evry nashon go honor mi and evribody for di world go praiz my name.”
Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
Make yu asept di way God kreate tins; abi e get who go fit strait wetin God don bend?
But Oga God dey en holy temple, so make evribody for di world, keep kwayet for en present.”