9 God go show dem di rizin. E go show dem dia sin and pride.
I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
bikos dem dey tok to God anyhow, dey make mout for di Oga wey dey mighty.
I bin dey sofa, bikos I waka live yor ways, but naw, I dey obey yor word.
My pains dey good for mi, bikos e dey tish mi how to listin to yor kommand.
My God, make Yu disgrace dem. Make dia own trap katch dem. Make Yu drive dem, bikos of dia sins and bikos dem don turn against Yu.
So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy. Doz wey Yu dey tish yor ways.
Oga God, di bad tins wey wi do against Yu, plenty well-well. Awa sins dey fight us and wi know sey na so e bi.
So Moses kollect silva kon buy di first-born for Israel back wey many pass Levi own.
Di law kom so dat sin go inkrease, but where sin get pawa, God grace strong pass am
But wen God judge and ponish us, E dey do am, so dat E nor go kondemn us with dis world.
Dis na true word and e good for evribody to asept and bilive am sey: “Jesus Christ kom dis world kon save sinnas” and na mi worse pass.