Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 36:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 True-true, God strong well-well! E nor dey feel sey pesin nor dey yuzful and e nor get anytin wey E nor undastand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 36:5
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E good as Yu dey opress mi? Yu dey opress wetin Yu make with yor hand. Yu dey happy for wetin wiked pipol dey do?


“Na God get pawa pass. E keep en kingdom wey dey heaven for peace.


If any of my savant komplain give mi, I dey listin and I dey trit dem well.


Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.


“So, na how I won take find word take ansa God?


Even if na to use pawa, E strong pass mi. Abi I go fit take am go kourt? Who go fit bring am kom di kourt?


Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.


Even doh God dey great, E dey kare for di pipol wey dey honbol demsef, but doz wey dey karry body up, e dey give dem shance.


Si as awa Oga God big rish! En pawa dey wonderful! Nobody fit undastand how God take dey know tins!


Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa. E neva turn en back to dem, but E dey listin to dia kry for help.


God dey listin to doz wey nor get help and E nor go forget en pipol wey dem dey ponish.


Di king dey strong; E love to judge well. God dey make sure sey dem judge evry kase well. Na Yu make betta judgement and raitiousness dey for Israel land.


Na God make di eart with en pawa; na-im wisdom and undastandin E take kreate di heavens and eart.


Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ