My God, Yu dey always trit mi well anytime wey I komplain give Yu. But I ask Yu one kweshon about good judgement: “Why e bi sey wiked pipol dey prosper and pipol wey nor dey honest, dey susid?
“Awa God! Na only Yu dey do wetin dey rite, but dem dey disgrace us evriday, bikos Judah, Jerusalem and all di pipol wey Yu skata go evriwhere, nor gri listin to Yu.
For judgement day, Sheba kween go kondemn di pipol for dis time, bikos e travel from far place kom hear Solomon wisdom. And naw, somebody wey big pass Solomon dey here with una!”
Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.
Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.