3 Or to ask God sey, ‘Wetin I go gain if I nor sin? Any nid dey to live klean life?’
If I sin, na big wahala Yu dey give mi, but if I do betta tin, Yu nor go gri reward mi. I don taya, na shame and trobol kover mi so.
Dem sey ‘Who bi dis God sef? Why wi go serve am? Any gain dey to pray to am?’
Wetin God for heaven choose for us? Wetin wi go gain from di Almighty wey dey heaven?
E sey pesin nor dey gain anytin, if e dey obey God.
I go ansa yu and all yor friends.
Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu?
So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin!
Una sey, ‘E nor get wetin pesin go gain if e serve God. Wetin bi di nid to do wetin E tok or try to show Oga God sey wi dey sorry for wetin wi do?’