8 E like make bad pipol dey stay with am and e dey waka with sinnas.
Yu feel sey yu words nor go make mi tok? As yu dey tok to God as yu like, so nobody fit tell yu sey wetin yu dey do nor good?
Na yor sin dey kontrol yor mout and na yeye words yu choose to tok.
But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.
Yu really won waka for di road wey wiked pipol dey pass?
E sey pesin nor dey gain anytin, if e dey obey God.
God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol!
I nor get time to spend with lie-lie pipol or waka with dem.
Wen una si tifs, una go hail and klap for dem and una dey spend una time with pesin wey dey sleep with who e nor marry.
My pikin, make yu nor follow dat kind pipol or go near dem at-all.
Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.
Wisdom go save yu from wiked pipol; from doz wey dey lie well-well.
Nor go where wiked men gada put or follow wetin dem dey do.
Make una nor let anybody deceive una, “Bad friends dey spoil good karata.”