7 Yu don si any man wey bi like Job wey dey tok anyhow?
Yu feel sey yu words nor go make mi tok? As yu dey tok to God as yu like, so nobody fit tell yu sey wetin yu dey do nor good?
Even my friends dey laf mi naw; dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. I bilive sey God go ansa my prayers.
how E won take bilive man wey dey drink bad and wiked tins like wota?
But naw, yu dey get di kind ponishment wey fit yu.
Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?
If witness for kourt dey tok wetin e nor si, den di judge nor go fit judge well. Wiked pipol like to dey do evil tins.
Wikedness and wahala bi like food and drink to dem.
“Make una make sure sey nobody among una wey dey hear dis tins today, bilive sey evritin dey okay with am, even doh e nor dey hear pipol word. Dis kind tin go skata all of una, weda una dey good or bad.