5 Make yu ansa mi if yu fit. Make yu dey ready and prepare yor kweshons.
But Pita hold am kon sey, “Stand up, bikos I bi ordinary human being like yu.”
As una dey do all dis tins, I nor tok at-all and una feel sey I nor kare. But naw, I go distroy una kon rite evritin wey I get against una.
Job dey tok to una; nor bi mi e dey tok to, but if na mi e tok to, I nor go ansa am di way wey una take ansa am.
I hear una well-well, but una nor fit show sey Job dey wrong; nobody among una fit ansa en kweshon.
So Job three friends nor gri ansa Job again, bikos dem know sey e dey tok trut.
I don dey ready to komplain gi-am, bikos I know sey I dey rite.
God tell Moses, “Make yu wake-up for early morning go meet Fero as e dey go di river kon tell am, ‘God sey, “Make yu let my pipol go serve mi!