Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.
My men go bring di woods from Lebanon kom di river kon tie dem togeda and float dem kom di place wey yu choose. Den, my men go luz dem and yor men go karry dem go. But I go like make yu give my men food.”
God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.
Evry word wey dey Bible, kom from God and dem dey good to tish us di trut and to know di tins wey dey wrong for awa life. God word dey korrect us wen wi dey wrong and e dey tish us to do good tins,