22 I nor sabi praiz pesin anyhow, bikos God go ponish mi, if I do like dat.
Pesin wey sell en friend bikos of money, na en shidren go sofa am.
I nor go support one pesin for dis matter and I nor go praiz anybody sef!
“Job, make yu listin and hear evritin wey I won tok!
All my words na true and na true I go tok.
E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am?
If yu korrect pesin, e go like am pass wen yu praiz am.
Pesin wey dey praiz en neighbour anyhow, dey set trap for dem.
Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
As una know, wi nor ever try to win una with sweet words. And God na awa witness sey wi nor dey pritend to bi una friends bikos of una money.