20 I must tok make I dey free! I nor fit bear-am again!
Make yu shut up yor mout, so dat I go tok. Wetin go bi, go bi.
Anybody fit argue with mi for dis matter? But if Yu sey I dey wrong, I go kwayet till I die.
“Job! Yu dey make mi vex. Naw, I nor fit wait before I ansa.
Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.
If una nor let mi tok, my belle go burst like wine wey dey new wine bag.
I nor go support one pesin for dis matter and I nor go praiz anybody sef!
“Job! Abeg, make yu nor vex for wetin I won tok, bikos I nor fit kwayet again.