16 Make I dey wait wen dem nor get anytin to tok? Dem just stand for der, bikos dem nor get anytin to tok again.
If to sey yu just kwayet, dat for bi wisdom for yu.
“Job, yor words too strong for all of dem; dem nor get ansa for yu.
But I go give yu my own ansa and I go tell yu wetin I dey tink.
Pipol go tink sey foolish pesin get sense wen e kwayet and wen e nor tok, e go bi like pesin wey wise.
So, to keep kwayet for dis kind evil time, naim bi di best tin to do!
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.