12 I hear una well-well, but una nor fit show sey Job dey wrong; nobody among una fit ansa en kweshon.
I kwayet dey listin to wetin una dey tok since; I dey listin to una wise word and as una dey tink wetin to tok.
So why una dey tell pipol sey una get wisdom? Naw, na only God go fit ansa am, bikos una don fail.
E still vex for Job friends, bikos dem nor know how to ansa Job and evritin kon bi like sey, na God dey wrong.
Dem won tish pipol di law, but dem nor undastand wetin dem dey tok, even doh dem dey tok with strong heart.