11 I kwayet dey listin to wetin una dey tok since; I dey listin to una wise word and as una dey tink wetin to tok.
“Wen I dey advise pipol, dem dey kwayet listin to wetin I dey tok
Evribody dey welkom mi, just as farmer dey welkom rain wey won fall.
Naw, I won tok and una go listin to mi. Make I tell una wetin I know.
I hear una well-well, but una nor fit show sey Job dey wrong; nobody among una fit ansa en kweshon.
Bikos na Elihu small pass for der, e wait until evribody tok finish.
Job, wi don study dis tin wey dey happen and wi know sey na true. So, hear dis words make yu use am for yor own good.”
Di first pesin to tok for kourt dey always dey rite, until di oda pesin ask am kweshon.
Rish pipol dey always tink sey dem wise, but poor pesin wey get betta karata, know di rite tin.