Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 31:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 If I don komot from di rite way; if my heart don follow wetin my eye si or if sin full my hand,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 31:7
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I dey pray to God from my heart, bikos I know sey I nor do any bad tin.


But doz wey get good heart, dey do wetin dey rite and di ones wey get klean hand, dey strong evriday.


Bikos I just dey waka follow God for back; for di road wey E choose by ensef and I nor dey waka on my own.


I nor go ever agri with wetin una dey tok! I go stand for my rite till I die.


I nor go ever give up, bikos I dey rite; my mind dey klean and my konscience nor dey judge mi.


Even if I use soap wosh my body and make my hand klean well-well,


I nor go even tink to do bad tin and I nor go join pipol do bad tins.


if I sin against my friend or ponish my enemies wen dem nor do anytin against mi,


Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.


Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite; wey nor dey shit poor pipol, bikos e get pawa and wey nor dey take bribe, join doz wey kill pipol or join do bad tins,


“Man pikin, dis pipol don give dia heart to juju and na di juju dey make dem sin. Dem tink sey I go ansa dem?


Wen ever any Israel pesin or strenja for Israel turn leave mi kon go serve juju, den e go ask profet kweshon, na mi wey bi God, go ansa am!


where dem go for bi strenja. Dat time, dem go remember kon know sey I don ponish and disgrace dem, bikos dia heart rijet mi and dem kon decide to serve juju. Dem go hate demsef, bikos of di bad and wiked tins wey dem don do.


Una must get dis tread, so dat wen una look am, una go remember all God kommand kon do dem and una nor go allow una heart or eye turn una from mi.


If yor rite eye go make yu sin, make yu plok am komot. E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ