Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 31:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Make God just test mi weda I dey klean and E go si sey I nor do any bad tin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 31:6
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yet, God know evry step wey I dey take. If E sey make E test mi, I go klean kom out like gold.


So Job three friends nor gri ansa Job again, bikos dem know sey e dey tok trut.


“If dem put my trobol and pains for skale,


dem go heavy pass san wey dey for sea, bikos dem dey heavy and na dis make knee dey tok like dis.


True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.


Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink! Test mi and Yu go know wetin I wont!


My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.


Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol, bikos God nor like am.


Pesin fit tink sey evritin wey e dey do dey korrect, but remember sey God dey judge evritin wey wi dey do.


Raitious pipol dey live korrect and good life and dia ways dey-dey strait.


Tekel (weigh) mean sey: ‘God don weigh yu for skale kon si sey yu dey lite.’


How I won take bilive una wey dey sell and measure with wayo cup?


Dat time, I go sey, ‘I nor know yu. Make yu komot from where I dey, yu wey wiked well-well.’ ”


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


“Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Na-im know di trut and Israel pipol must know di trut too. If wi don sin or disobey God, make una nor sorry for us today!


Make una stop to tok anyhow; make betta word dey kom out from una mout, bikos di Oga God na God wey know evritin wey pipol dey do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ