5 I neva do wiked tin before and I neva ever lie to anybody.
If dem nor get sense rish and dem kon dey bilive bad tins, na di bad tins go follow dem.
Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.
I nor get time to spend with lie-lie pipol or waka with dem.
Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?
Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.
God sey, “Wetin una grand-grand papa dem sey I do wey make dem waka leave mi? Dem go woship yuzles juju and e kon make dem dey yuzles too.
Den God kon tell mi: “Una words na lie and una vishons nor go happen. I really dey vex for una.
If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!
“Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Na-im know di trut and Israel pipol must know di trut too. If wi don sin or disobey God, make una nor sorry for us today!