Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 31:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 I nor dey kwayet or stay for inside house, bikos I dey fear sey pipol go curse or tok against mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 31:34
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di ofisas shaut with Hibru language make Jerusalem pipol wey dey di wall, fear run komot, so dat dem go fit seize di town.


Naw, Eliashib wey bi di priest born Joiada, but one for Joiada pikin marry Sanballat dota, wey kom from Bet-Horon town, so I sey make Joiada komot from Jerusalem.


Afta I tink about am well-well, I kon tok against di ofisas and doz wey get money. I tell dem, “Una dey opress and ponish una own brodas as una dey take intrest wen dem borrow money from una!” Bikos of dem, I kon koll evribody togeda make dem tok for di matter.


“If anybody, weda na man or woman enter di inna kourtyard go si di king without sey e koll am, dat pesin must die. Dat na di law; evribody from doz wey dey advise di king go rish evriwhere for di kingdom, know sey na so e bi. But na only one way wi fit take break dis law: if di king show pesin en gold rod, den dem nor go kill dat pesin. But e don rish one mont since di king sey make dem koll mi kom.”


If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”


Yu dey opress pipol with yor pawa and pozishon.


E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.


“Make una nor follow pipol do wiked tins; for inside yard, make una nor tok wetin una eye nor si, bikos plenty pipol dey tok am to take win dia kase


Moses tell dem, “Di Oga wey bi Israel pipol God sey, ‘Make evribody karry dia swod, bigin kill each oda thru-out di kamp. Make una bigin kill unasef, brodas, friends and neighbours.’ ”


E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.


So King Zedekaya promise mi for sekret sey, “I swear with God wey dey alive and wey give us life sey, I nor go kill or give yu to di men wey won kill yu.”


But di king ansa, “I dey fear awa own pipol wey don already surenda to Babilon king. Babilon king fit give mi to dem and dem go sofa mi.”


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ