Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 31:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 I dey always help poor pipol; I neva let wimen wey nor get husband live for pain

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 31:16
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

bikos dem don beat and kollect from pipol wey nor get. Dem still seize dia house,


E dey give hope to di poor kon silent wiked pipol.


Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.


I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi; so dat evritin go bi just as Yu promise mi.


My eye just dey look to si sey wetin Yu promise, dey happen. So wen Yu go kom help mi?


I don taya to dey shaut for help; sore dey my trot naw and my eye don taya to dey look for my God.


“Make una nor sofa wimen wey dia husband don die or shidren wey nor get papa and mama.


Make yu nor trit poor pipol anyhow bikos yu get pawa! Doz wey nor get help for kourt, make yu nor trit dem anyhow too,


E dey always give tins to poor pipol and to doz wey know get at-all.


Una dey opress poor pipol and nor gri give dem dia freedom. Una dey do like dis, so dat una go fit tif from shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die.


I nor fit shaut and I dey weak kon dey do like dove. My eyes don taya to dey look heaven. So God, make Yu save mi from all dis trobol.


Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.


opress or tif from pipol. Dey riton wetin pesin gi-am to take borrow money. Dey feed pipol wey dey hongry kon give klot to doz wey dey naked


“ ‘If una fellow Israel pesin dey poor and e nor fit support ensef, una must gi-am evritin as una dey give di pipol wey una hire, so dat dem go kontinue to stay with una.


E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey use long prayer shit wimen wey dia husband don die, bikos of dis, God go ponish una well-well.”


Di same way, di savant wey get two koins, gain two estra koins join en own.


e dey wait to chop wetin fall from di rish man tabol. Dogs sef dey kom lick di sore for en body.


So di disciples, evribody akordin to how e fit do rish, kon sey dem go send money go give di brodas wey dey Judea.


But dem sey make wi always remember poor pipol and na wetin dey my mind to do, bi dat.


God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin.


But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ