31 I nor fit remember di last time wen I hear betta music, bikos na only song wey go make mi mourn and kry, naim dem dey play.
I just dey waka for darkness and I nor dey si lite at-all. I dey beg for help for where crowd Gad put.
Time dey to kry and time dey to laf; time dey to mourn and time dey to dance.
My heart dey shake and I dey fear well-well. Before, I dey like wen evening rish, but naw, I dey fear darkness.
For dat time, Oga God wey dey lead heaven sojas kon sey make una dey kry, mourn, shave una hair and wear sak klot.
Joy nor dey awa heart again bikos wi wey bin sabi dance, don turn who dey mourn naw.
Den di king go back to en palis. But for nite, di king nor fit chop, sleep or sey make dem play music for am.
“I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.