12 Dem gada kon fight mi; dem drive mi from one place to anoda and dem don agri for wetin dem go do mi.
Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.
En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house.
Shidren sef dey laf wen dem si mi. Wen I won tok, dem go turn waka leave mi.
Dem go dey fight each oda; Men go oppoz each oda and neighbours go fight against dia neighbour. Yong pipol nor go respet dia senior and foolish pipol go dey curse doz wey dem bin dey respet.”