11 Bikos God don make mi weak and I nor get who go help mi; dem kon use all dia vexnashon take face mi.
E dey remove kings from dia throne kon make dem prisonas.
E disgrace princess kon take pawa komot from rulers hand.
So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense and wey nid kane to kontrol am.”
Dem go dey shaut, “Yes o-o! Yes o-o! Wi don get am at last!”
Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi.
If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin.
I komot here with my husband and shidren, but God don make mi kom back with empty hand. Wetin make una dey koll mi, ‘Naomi,’ wen una si sey God tok against mi and di One wey get pawa don make mi dey sofa?”