9 Make en morning star remain darkness. Even wen e find lite, make e nor si am and make en day nor break.
Make Yu curse di day wey my mama born mi, bikos na-im make mi dey face all dis trobol so o-o.
Make di pipol wey dey curse day, curse am! Make di pipol wey dey curse wota juju, curse am too.
Na happiness and lite I dey hope for, but na trobol and darkness I kom get.
Wen dem don make am vex, e go shaut and nobody go try go stand for en front.
Wen e sneeze, lite go flash kom out and na so en eye dey shine like sun for aftanoon.
Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.
Even wen wi pray for peace, na wahala dey follow us. Wi bilive sey wi go rest small, but na trobol dey porshu us.