25 And naw, evritin wey I dey fear, don dey happen to mi so o-o.
One dia party finish, Job go koll and santify dem. For early morning, Job go offa sakrifice for all of dem. “Bikos e bilive sey dem fit nor know sey dem don sin and curse God.” Job dey do dis tin evritime.
Fear don chop my full body; my respet don go like wota proof wey breeze blow and my glory don vanish like kloud.
Na happiness and lite I dey hope for, but na trobol and darkness I kom get.
But bikos I dey fear God ponishment, I nor fit do dat kind tin.
my trobols go still kom back again; den I go know sey Yu dey hold mi bikos of di bad tins wey I do.
Shebi una dey fear swod? So, I go fight una with men wey karry swods.