22 Dem dey-dey happy wen dem die go dia grave.
But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”
Pipol go many for dia burial and di san go kold for dia body.
Dem dey find deat, but dem nor dey si am; dem dey find am pass wetin dey precious.
Wetin God give lite to doz wey nor get tumoro, pipol wey God surround with wahala?
Aldo I get mind with dis sey: Even with all di pains wey I get, I neva ever go against God word.
“Why God nor gri give mi wetin I ask for? Why E nor ansa my prayer?
E betta make I kill mysef, dan dis kind wiked life wey I dey live.
So I sey, e betta well-well for pipol wey don die, pass doz wey still dey alive.
But di ones wey dia own betta pass, na shidren wey dem neva born, bikos dem neva si all di wiked tins wey dey happen for dis world.
But I nor go kill dis wiked pipol finish, instead I go skata dem go difren place where dem go for dey beg make dem die. Mi, wey bi God, don tok.”