16 Why dem nor beri mi like pikin wey die before dem born am? Like pikin wey nor live to si di lite?
To die for my mama belle, for betta pass dis one wey I dey so.
I for dey rest with prince wey get gold and wey silva full dia palis.
Bikos for grave, wiked pipol nor fit do evil and evribody wey dey der, dey rest.
Make dem bi like snail wey dey die as dem dey waka! Make dem bi like pikin wey dem just born, wey nor ever si sun before e die!
God go swip dem trowey kwik-kwik, even before pot wey dem put for fire, go dry.
But di ones wey dia own betta pass, na shidren wey dem neva born, bikos dem neva si all di wiked tins wey dey happen for dis world.
If pesin get hundred shidren and e stay for dis life kon old, but if e nor get happiness and dem nor do betta beri for am, den I go sey, “Pikin wey dem just born and e die, betta pass am.”
Finally, e appear to mi; even doh I bi like pikin wey dem born before di time rish,