2 “If to sey my life go fit bi as e bi before wen God dey look and guide mi!
Yu dey kover en, en family and all di tins wey e get; Yu bless evritin wey e dey do and Yu don gi-am plenty animals.
Mont to mont, I nor get anytin to live for; evry nite dey kause pain for mi.
Bikos God like to dey judge well and E nor go ever leave doz wey dey fear am.
And just as I make sure sey dem rut, pul, ova-trow, distroy and skata dem, na so too I go make sure sey dem plant and build dem back again.
Dis leta na from Jude, Jesus Christ savant and James broda. To di pipol wey God don koll, wey Papa God love don wrap like klot for Jesus Christ body.