23 Na only God know di way and place where dem fit si wisdom,
“But where wi go fit si wisdom? Where wi go fit learn how to undastand?
“But where wisdom from kom sef? Where wi go for fit learn how to undastand?
God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.
Si as awa Oga God big rish! En pawa dey wonderful! Nobody fit undastand how God take dey know tins!
God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.
Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.
Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.
Evritin wey don happen, too hard for human being to undastand; dem too deep for us to tink about.
“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.
and E know sey na so e go bi.
Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!
Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;
Make all glory, majesty, pawa and authority, bi God own, naw and forever thru Christ wey bi awa Oga God. Amen!