12 “But where wi go fit si wisdom? Where wi go fit learn how to undastand?
So, make Yu give mi wisdom to rule yor pipol with good mind and to know wetin dey good or bad. If not, how I go take rule dis yor many pipol?”
Dem dig rish wota kon bring wetin dem hide, kom out for lite.
“But where wisdom from kom sef? Where wi go for fit learn how to undastand?
Na only God know di way and place where dem fit si wisdom,
God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”
But even before dem born mi, Yu don plan betta tins for mi kon dey tish mi wisdom.
God kreate di eart with en wisdom and na en undastandin E take make di heavens.
Wisdom dey sweet well-well wen money dey, bikos both wisdom and money dey good well-well for dis life.
Bikos all di wisdom and knowledge wey God get, E hide dem inside Christ.
bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.
But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.