Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 28:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Job sey, “Where dem for dey dig silva, na der precious stones dey and e still get where dem for dey rifine gold too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 28:1
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“My oga, di land na 400 silva, but dat one nor mean anytin at-all. So go beri yor wife for der.”


Afta di kamels don drink finish, di man bring one gold ring wey dem dey put for nose and two gold shain for waist kon gi-am to di girl.


Na gold dem take make di cup wey Solomon take dey drink wota and all di spoons and plates wey dey di hall for Lebanon forest. Dem nor use silva, bikos silva nor get value for Solomon time.


Strong breeze go push dem as dem dey run and with en pawa, e go porshu dem komot from where dem dey.”


Na from groun dem for dey dig iron and melt koppa.


God promise dey pure well-well like silva wey dem melt for fire.


Na fire dem take dey test gold and silva, but na God dey test pesin heart.


Just as dem dey take fire test gold and silva, na so too dem dey test pesin good name.


Naw, make una si as I don klean una and nor be like silva; but na betta sofa and wahala I take test and klean una.


I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”


Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ