Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 27:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 and as dem dey try to run, God nor go sorry for dem and E go blow dem fall.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 27:22
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand.


But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”


Wen dem won run, bikos of iron swod, di bronze bow go shot dem fall.


E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.


Bikos dis time, I nor go only ponish yor savant and pipol, but I go ponish yu too, so dat yu go know sey nobody bi like mi for di whole world.


Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?


E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”


“Mi God don tok. Di time don rish for mi to do wetin I won do. I nor go let una sin finish kon go like dat or sorry for una. I go ponish una for wetin una don do.” God wey get pawa don tok.


“So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una.


Even doz wey dey run fast nor go fit eskape; strong men nor go get pawa again and sojas nor go fit save dia own life.


Wen dem hear wetin e tok, fear kon katch dem well-well, so dem ask am, “Wish kind tin yu do so?” Di men tok like dis, bikos dem know sey e dey run from God, just as e bin tell dem.


True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!


God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own.


I go inkrease dia wahala, I go use all my arrow for dia body.


As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.


Anybody wey dey porshu and won kill yu, di Oga yor God wey dey heaven go protet yor life and nor-tin go happen to yu. But e go skata and kill yor enemies, wons and for all.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ