20 Just as wota dey karry tins go, na so too fear go karry dem go and for nite, breeze go blow dem trowey.
For dat nite, God send en angel go kill 185,000 sojas for Assyria kamp. Wen day break, all of dem don die.
Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.
Fear dey wait dem for evriwhere and e go follow dem as dem dey waka.
Make God feed dem beleful with trobol. Make God pour in vexnashon for dia head like evening rain dey fall.
Dem go vanish like dream and vishon for nite and pipol nor go si dem again.
How many times dem bi like leaf wey breeze blow trowey or dust wey breeze karry go?
Even before dia time end, wota don karry dem go.
But na wota go karry wiked pipol go; God go curse dia land and nobody go work for dia farm again.
Pesin fit die for nite just like dat, but God nor dey struggol to distroy pipol wey tink sey dem get pawa.
Deat dey round mi and trobol won kill mi;
I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.
My God, make Yu disgrace dem finish until dem bigin praiz yor name.
Yu dey swip pipol trowey like dream wey dey vanish. Dem bi like grass wey grow for morning.
Dat nite, Oga God kill all di first-born son for Egypt and na from Fero first-born go rish doz wey dey prison and di animals first-born.
So for dat nite, dem kon kill Belshazzar wey bi Babilon king.
Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.