Dem skata where I dey stay won kon take my life like tent wey dem pul from groun; like klot wey dem kut komot from machine. Yes! I bin tink sey God won end my life.
E distroy en temple like sey na vineyard kon skata where wi for dey woship am. God make Zion pipol forget dia festival and Sabat Day. Naw, kings and priests don fall, bikos E dey vex.