For dat same day, King Zazes give Kween Estha all di propaty wey Haman, Jew pipol enemy, get. Estha tell di king sey Mordekai rilate to am and from dat day go, Mordekai kon dey enter di palis as e like.
God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.
“But very soon, di pipol wey dem katch, go ponish who katch dem. Dem go sey, “ ‘Una take wetin nor bi una own and naw, una own don finish! But na how long dis kind tin go kontinue?’