12 But I nor go tish yu, bikos yu don si am by yorsef. So wetin make yu dey tok all dis bad tins?”
All dis yeye word wey yu dey tok neva taya yu? Wetin make yu still dey ansa mi?
Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.
Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.
Make I tish yu how God pawa strong rish. Make I tell yu about di Almighty God plan.
Zofar ansa, “Na so God take dey ponish pipol wey dey like trobol and do wiked tins.
E still get oda yuzles tins for dis world: Sometaims, wi dey trit good pipol like sey dem wiked, den trit wiked pipol like sey dem dey good and na dis dey yuzles pass.