9 Na-im use di kloud take kover di moon.
Den Solomon kon pray, “Oga God, Yu sey Yu go stay for darkness.
Yu feel sey as di kloud tick rish, God nor go si as E dey waka for heaven?
God kover Israel pipol with kloud kon give dem big fire as lite for nite.
Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.
Di pipol stay far from di place, but Moses waka near di tick kloud, where God dey.
Make nobody follow yu klimb or near di mountin. Make any animal nor kom chop grass under di mountin.”
Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!