6 Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.
God high pass di heavens; so wetin yu go fit do? E deep pass where dead body der; so wetin yu feel sey yu know?
Deat and distroshon agri sey, na hear dem just dey hear.
If to sey I die dat time, I for dey rest naw;
Make e bi like hell-fire wey dey distroy tins; fire wey go burn evritin wey I get.
Anybody don ever show yu di gate wey dey guide where dead body dey?
Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own?
E dey move mountins anytime E wont kon skata dem with vexnashon.
Even if I sey, “darkness go kom and day go turn to nite around mi,”
If I run go heaven, Yu dey der; if I die go grave, Yu dey der too.
All di wonderful tins wey Yu dey do nor mean anytin to pipol wey don die. Abi dead body go fit raiz-up kon praiz Yu?
Even Deat and Distroshon nor get sekret for where God dey, tok-less of human being heart!
Just as grave nor dey taya to take dead body, na so too di tins wey pipol wont for dis world, nor dey satisfy dem.
Pipol wey don die, dey happy to welkom Babilon king. Pipol wey dey strong well-well wen dem dey life, dia ghost dey wait am and all di former kings ghost raiz from dia throne dey wait am too.
All di sekret tins wey dem hide, E dey bring am out; E know wetin dem hide for darkness and na lite E take kover ensef.
Even if dem dig and hide for inside grave, I go still katch dem. And if dem klimb go heaven, I go bring dem kom down.
Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.
Na dia king bi di angel wey kom from di pit and en name for Hibru, na Abaddon and for Greek, na Apollon (pesin wey dey distroy).