13 Wen E breath, di sky dey klear. Na en hand E take distroy di big snake.
Di eart nor get shape at-all. E dey empty and darkness kover di wota, but God Spirit dey waka on-top di wota.
Na only en make di heavens kon waka on-top wave for sea.
Na yor breath wey dey give life, Yu take kreate dem kon make dem plenty for dis eart.
For dat day, God go use en great and pawaful swod take ponish and distroy Leviatan; dat dragon wey dey twist and waka fast-fast. Yes! God go kill di great monsta wey dey inside sea.
Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.