Even wen una plant, una nor go harvest anytin. Una go press una olive fruit, but una nor go get enough oil to anoint unasef. Una go mash di grape, but una nor go get any wine to drink.
Dem go chop una animals pikin and una plants, den dem go distroy una. Dem nor go leave any korn, new wine, olive oil or animals for una and una go hongry die.