Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 24:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Dem nor let poor pipol get wetin dem suppose get and doz wey nor get at-all, dey run go hide.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 24:4
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For day break, wiked pipol go get up go kill poor pipol and for nite, dem go-go tif dia propaty.


Wen poor pipol kry kom meet mi, I dey help dem; I dey help pikin wey nor get papa and mama and doz wey nor get where to go.


I bi like papa to poor pipol and I dey setol matter even for doz wey I nor know.


Abi I nor follow pipol wey dey trobol kry kon sorry for pipol wey nor get at-all?


I dey always help poor pipol; I neva let wimen wey nor get husband live for pain


If I si pesin wey nor get at-all; wey won die, bikos e nor get wetin to wear,


Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.


Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol! God dey always save dem from trobol.


Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.


If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor pipol make yu for get more money, yu go poor too.


Wen good pipol dey rule, evribody dey happy, but wen bad pipol dey rule, evribody dey hide.


Pipol dey hide wen wiked pesin dey rule, but wen e nor dey again, raitious pipol go prosper.


“Dia tit bi like swod and dia mout sharp like knife. Dem dey distroy poor pipol komot from dis eart and pipol wey nor get food to chop, dem dey kill dem trowey.


Una dey opress poor pipol and nor gri give dem dia freedom. Una dey do like dis, so dat una go fit tif from shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die.


Or dey play poor pipol wayo; dey tif, dey keep wetin pesin gi-am, so dat e go borrow am money; dey follow sinnas go woship dia juju


But for en papa wey play wayo, tif and dey wiked to evribody, go die bikos of di sins wey e kommit.


Doz wey get money dey shit and tif from oda pipol. Dem dey ponish poor pipol and dey kollect strenjas propaty.


Dem dey mash poor pipol head for san-san kon push doz wey nor get who go help dem komot for road. Papa and pikin dey sleep with di same woman and like dis, dem don spoil my name wey dey holy.


Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan! Una dey ponish pipol wey nor strong, wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry, den una go tell una husband, “Give us more wine make wi drink.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ