3 Shidren wey nor get papa and mama again, dem dey take dia donkey and bikos of di money wey wimen wey nor get husband dey hold, pipol dey seize dia animals.
If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.
Naw, as I dey here so, anybody fit tok bad about mi before God and di king wey E choose? I don use force take anybody animal? I don do anybody wrong? I don opress anybody? I don take bribe from anybody hand wey make mi nor tok trut? Make una tell mi and I go ansa una!”