20 Even dia mama nor go remember dem again. Na worm go chop dem and dem go bi like tree wey dem kut trowey.
If I sey, ‘Grave na my papa’ and di worm wey dey chop mi, ‘Na my mama and sistas,’
E skata mi for evry side, until I nor get hope again.
Even wen sickness don chop my skin, as I still dey dis body, I go si God.
But evribody must die. Dem dey beri who don die and worm dey kover di body.
If to sey I die dat time, I for dey rest naw;
But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins; E dey remove dem from dis eart.
Pipol go remember good pesin bikos of di good tins wey e do, but dem go soon forget wiked pesin forever.
I si as dem beri wiked pipol with honor, but God pipol dey komot di holy town and pipol dey forget dem. All dis tins nor make sense at-all.
Dis pipol don die and dem nor go kom back again. Dia spirit nor go fit raiz-up again, bikos Yu don judge and distroy dem.
Den God ansa, “E get any woman wey fit forget en own pikin wey e born? But even if mama fit forget dia pikin, I nor go ever forget una.
E shaut kon sey, ‘Make una kut di tree kon distroy en branches; remove en leaf and skata en fruits. Make una drive di animal komot from under am and di birds wey dey en branches!
Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire.