16 For nite, tif go break enter pipol house, but for day time, di tif go-go hide from lite.
E get pipol wey rijet di lite; dem nor undastand di lite or follow where e dey lead dem go.
“Di priest among una go karry en load put for shoulder kon waka enter darkness. E go break di wall where e go trow en load pass. E go kover en face, so dat e nor go si di land with en eye.
But make una remember sey: If pesin wey get house know di time wen tif go kom for nite, e go ready ensef make di tif nor for enter en house.
“Make una nor just gada propaty for dis world, bikos siti-siti go chop dem or dem go rust or tif fit enter inside di house tif dem.
Yu si, evribody wey dey do bad tins dey hate lite and dem nor go gri kom out for where lite dey, make pipol nor for si di bad tins wey dem dey do.