14 For day break, wiked pipol go get up go kill poor pipol and for nite, dem go-go tif dia propaty.
E get pipol wey rijet di lite; dem nor undastand di lite or follow where e dey lead dem go.
Dem nor let poor pipol get wetin dem suppose get and doz wey nor get at-all, dey run go hide.
God won judge doz wey dey lead en pipol. E sey, “Na una skata di vineyard kon pak poor pipol tins full una house.
But make una know sey, if di owner of di house know wen tif dey kom, e nor go let di tif break enter en house.
Bikos una really know sey, di day wen Christ go kom, e go bi like wen tif dey kom for nite.
Make yu remember wetin yu don hear and receive and make yu obey dem kon turn from sin kom meet God. If yu nor shine yor eye well, I go kom like tif and yu nor go know di time wen I go kom.