Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.
“God don blind dia eye and make dia heart strong like stone, so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart, so dem nor go fit kom meet mi, make I for heal dem.”
Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.
Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
And I still dey remind una about di angels wey nor stay for where God put dem, but kon komot for where dem suppose dey. God don shain dem tie for darkness until wen E go judge di world.