True-true, God wey dey lead di sojas for heaven don plan di day wey E go judge evritin, bikos E go disgrace di pipol wey feel sey dem get pawa and dey make mout.
Even una small family wey dey honbol demsef, go dey great like nashon wey get pawa well-well. Wen di time rish, I go make dis tins happen kwik-kwik. Na mi wey bi God, tok am!”
Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.
So make una stand for God wey get pawa front, bikos di wonderful day wen God go judge di world, don near. God don prepare to distroy en pipol and E don choose who go kill dem.
But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.