8 I don find am go east, but I nor si am. I nor si am for west wen I find am go der too.
Wen God dey work for nort and sout, I nor still si am.
If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.
Yu sey yu nor fit si God; but make yu dey patient, bikos yor matter dey en hand.
Even if God pass naw, I nor go fit si am. If e waka pass, I nor go even smell am sef.
My God, wetin make Yu stand far from mi? Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?
Yu dey my front kon still dey follow mi for back and yor blessings dey my head.
True-true, na Yu bi Israel God and Savior and Yu bi God wey nor dey show yorsef.
Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!