Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 22:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Nor bi only sey yu nor gri help wimen wey nor get husband again, but yu dey ponish and kollect from shidren wey dia papa and mama don die.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 22:9
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dey ponish wimen wey dia husband don die and doz wey nor get pikin.


Shidren wey nor get papa and mama again, dem dey take dia donkey and bikos of di money wey wimen wey nor get husband dey hold, pipol dey seize dia animals.


If I don ever do bad to who nor get papa and mama, bikos I know sey I go win di matter wen wi go kourt,


Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.


Make Yu break wiked and evil pipol hand! Make Yu ponish dem for dia wiked plans wey dem tink sey Yu nor know about.


God go take wiked pipol pawa, but E go protet doz wey dey fear am.


Dem dey kill wimen wey dia husband don die, strenjas and shidren wey nor get papa and mama again.


Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”


Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.


Una dey opress poor pipol and nor gri give dem dia freedom. Una dey do like dis, so dat una go fit tif from shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die.


Dem don break and distroy Moab pipol pawa. Mi, wey bi God, don tok.”


Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.


Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘I bi Egypt pipol enemy. I go break di king two hand; both di one wey good and di one wey don break before, den en swod go fall for groun.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey use long prayer shit wimen wey dia husband don die, bikos of dis, God go ponish una well-well.”


Strenjas, pesin wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die, if anybody nor judge dia kase well, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ