4 God dey ponish yu, bikos yu too obey and respet am?
Yu dey open eye look dis kind pesin? Yu go gri judge mi so?
Abeg, I nid pesin wey go help mi beg God, just as pesin dey beg en friend.
But fear di swod naw; dat swod wey dey bring God ponishment. So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”
Yu feel sey God get gain from di good tins wey yu dey do or di rite way wey yu dey follow?
Wi nor fit set di time wey God go take judge all of us.
Why Yu put mi for kage make pipol dey look mi? I bi wota juju?
Even if na to use pawa, E strong pass mi. Abi I go fit take am go kourt? Who go fit bring am kom di kourt?
If to sey God na pesin, I for ansa am. Wi for go setol awa matter for kourt.
Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.
Wen Yu ponish us for awa sins, Yu dey remove awa pawa like rat wey dey chop pesin food. But each of us, na just breeze wey dey blow pass.
My Oga wey bi Jakob God, wen Yu breath, all yor enemies horse and shariot dey fall die.
Make awa enemies nor chop and burn us finish. Make dem die, bikos Yu nor dey happy with dem.
For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.
I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!