Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 22:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Wen yu pray, E go ansa yu and yu go keep di promise wey yu don make.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 22:27
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jehoahaz kon tell God make E forgi-am and God ansa en prayer, bikos E si sey King Hazael really dey sofa Israel pipol.


Jabez kon pray, “Israel God, make Yu bless mi and let my land big well-well. Make yor hand dey with mi kon save mi from trobol, so dat sofa nor go kill mi!” So God kon ansa en prayer.


Wen e pray to God, God hear and ansa en kry for help. God bring am kom back to Jerusalem wey bi en kingdom. Den Manasseh kon know sey na di Oga bi di true God.


But for yu Job! Make yor heart dey rite before yu koll God.


God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?


Den wen e pray, God go ansa am. E go woship God with happiness. God go make am dey raitious for en eye again.


Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help.


if yu klean yorsef kon koll am yor Savior, E go help yu kon give yu back evritin.


I love God, bikos E dey hear my vois and my prayer for help.


I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.


My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.


Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.


Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.


Wen yu promise God sometin, make yu do am kwik-kwik, bikos E nor get anytin to do with fools. So make yu do wetin yu promise.


Wen una pray, I go ansa una. Wen una koll mi, I go hear una. If una stop to opress pipol and tok wiked words kon stop wiked tins;


Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una.


But as for mi, I go sing praiz Yu; I go offa sakrifice give Yu kon do wetin I promise, bikos na only Yu fit save mi!”


Wen una make promise give di Oga una God, make e nor tey before una do wetin una promise, if not, God go hold una sey una don sin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ